Tuesday, July 19, 2016

JUST FOR LAUGH

. 🇳🇬Chicken wey run away from Borno go Ibadan go still end up inside pot of soup;
YOU CANT RUN AWAY FROM YOUR DESTINY.

🇳🇬Today's newspaper na tomorrow suya wrap;
KEEP CALM NOTHING LAST FOREVER.



🇳🇬Cow wey dey in a hurry to go America go come back as corn beef;
JUST BE PATIENT LET THE
GAME COME TO YOU, DON'T RUSH.

🇳🇬Akara and moinmoin get the same parent, na wetin dem pass through make dem different;
HOW YOU START DOESN'T MATTER, WHAT MATTERS IS HOW YOU FINISH.

🇳🇬If life show you pepper, my guy make pepper soup
from it;
MAKE SOMETHING GOOD OUT OF A BAD EXPERIENCE.

🇳🇬I get am before no be property;
STOP LIVING IN THE PAST AND START LIVING IN THE PRESENT.

🇳🇬If person too tey for party e go follow dem wash plate;
DON'T OUTSTAY YOUR WELCOME.

🇳🇬Craze no hard to form na d trekking be wahala;
EASIER SAID THAN DONE.

🇳🇬No matter how hot your temper be, e no fit boil beans;
CALM DOWN, YOUR TEMPER WON'T SOLVE THE PROBLEM.

🇳🇬Every mallam with im own kettle, every northerner with im own radio;
EVERY MAN FOR HIMSELF.

🇳🇬Frog eye no be open eye:
HAVING BIG EYES DOESN'T MAKE YOU CIVILISED.

🇳🇬Bring suya...bring suya, na cow body dey suffer am;
EVERY ACTION HAS A CONSEQUENCE.

🇳🇬E go better e go better na im make ibo man still dey kano;
WHEN THERE IS LIFE THERE'S HOPE.

🇳🇬The difference between ipekere and plantain chips na packaging;
DONT JUDGE BASED ON
APPEARANCE ALONE.

🇳🇬Escort me, escort me, na so slave trade take start; SERIOUS THINGS SOMETIMES START LIKE
JOKE.

🇳🇬Pikin wey use agbada take start, abeg wetin e go
wear wen e old;
SLOW AND STEADY WINS THE RACE.

🇳🇬The water wey dem use make eba can never be
recovered back;
DONT CRY OVER SPILLED
MILK...

COOL DOWN...GOD KNOWS ALL AND HE ALONE IS IN CONTROL OF ALL THINGS BECAUSE HE IS GOD ALONE AND ABOVE ALL THINGS.

No comments:

Post a Comment

Apostle Johnson Suleman Prophecies for 2021

  Apostle Johnson Suleman has released a shocking prophecy ahead of 2023 election.